Monday, December 23, 2024

Who be Naana Jane Opoku-Agyemang Ghana first female vice president-elect?

 

Who's Ghana first female vice president-elect?

Foto of Naana Jane Opoku-Agyemang

Wia dis foto come from,Naana Jane Opoku-Agyemang/facebook

Ghanaians especially women dey celebrate di historic win of former education minister, Naana Jane Opoku Agyemang as vice president for di just concluded elections for Ghana.

She dey set to be di first female vice-president of di kontri.

Prof Opoku-Agyemang alongside John Mahama run dia successful campaign under di political party National Democratic Congress (NDC), dem dey head into Ghana Jubilee house for January 2025.

Di 73-year-old enta Ghana politics as minister of education under di presidency of John Mahama for 2013 until 2017. During her time for office, she make difference by constructing modern classroom facilities, providing free textbooks and school uniforms for Ghana citizens.

In 2020, John Mahama bin select her as im running mate under NDC party but dem no win di election.

She don break many records and make history as academia, she hold di position of di first female vice-chancellor of University of Cape Coast from 2008-2012

She don collect local and international awards, including honorary doctorate award.

Prof Opoku-Agyemang na human right activist wey dey advocate for quality education and end to gender-based violence against Ghanaian women.

Profile of Naana Jane Opoku-Agyemang

Young Prof. Opoku-Agyemang wit her pikin

Wia dis foto come from,Prof. Opoku-Agyemang/X

Dem born Naana Jane Opoku-Agyemang on 22 November 1951.

She come from Cape Coast in Ghana. She don earn many prestigious academic degrees and awards.

She earn her Bachelor and Diploma in Education from di University of Cape Coast, Master and Ph.D. in English Literature from York University in Canada.

She dey among di executive board of di United Nations Educational, Scientific and Cultural Organization (UNESCO) and di editorial board of Harriet Tubman Series on di African Diaspora (Africa World Press Inc. USA).

Prof Opoku-Agyemang get many publications on women in literature, oral literature in Africa and she be member of di Ghana Academy of Arts and Sciences and Fellow of di Commonwealth of Learning.

Prof Opoku-Agyemang wey marry 40 years ago, get three pikin and two grandchildren from her pikin dem.

Her role in Ghana politics dey progressive for women wey dey di kontri as she dey ginger dem to pursue political leadership for Ghana.

She dey bring fresh perspective to national policies wey go advance di educational sector in Ghana.

During di period she serve as minister - she win di award for di best performing minister.

No comments:

Post a Comment

kissiwisdom4@gmail.com